Friday, April 19, 2024
- Advertisement -

Open Letter To Rapists – Flourish Joshua

Share

Una wey konji dey hol, how market?
Shebi una dey use Aunty play una antics,
Una well done o!

Konji no be bastard.
If konji hol you,
E mean say, ‘body no be firewood’.
Konji hol you no mean say
Make you hug am.

Konji hol you no mean say
Make you loose guard enter person pikin.
Konji hug you no mean say
Make you marry am.

No dey ‘access’ person pikin like say na bank,
Reason this mata well well.
This tori no dey sweet us yan,
But as the mata be ehn, we go yan.

Resist the urge now
and Resist the urge to shalaye later.

Flourish Joshua
IG|Twitter @fjspeaks
+2347056360775
flourish6880@gmail.com

Yeye blogger
Yeye bloggerhttps://naijahotstars.com/
Being a blogger is the best thing that has ever happen to me. When i'm off duty as a blogger i'm on the field shooting every living thing on sight with my Camera SMILES!. Feel free to follow me on social media let's link up.

Trending

Recent